Gas explosion in Lagos today: Iju-Ishaga gas tank truck fire outbreak for Ifako-Ijaiye and wetin we know so far

 






One loud explosion burst Ajuwon, Iju-Ishaga area of Lagos on Thursday afternoon injure at least 30 pipo wey get different kinds of degrees of wounds.


Na LP Gas tank truck fire outbreak for Ifako-Ijaiye cause di Iju-Ishaga gas explosion.


E happun around 3:30pm on Thursday near Cele Bus Stop, along Grailand, Ajuwon.


Black Wednesday as Kogi tanker explosion kill at least 28 pipo - Read wetin we know so far

"Iju-Ishaga Gas Explosion in Lagos"

WIA DIS FOTO COME FROM, LASEMA

Eyewitness tell BBC say na truck wey cari gas na im explode as e dey try to offload.


BBC Pidgin find out say even pipo wey dey far away from di exact location of di explosion get deep wound from di explosion.


Chief of Air Staff Nigeria: Sadique Baba Abubakar dey married? yes! Dis na everitin to know about di Air Marshal

Meet Sadiya Umar Farouq, President Buhari youngest cabinet minister

20 Adults male and 10 adults female na im wound, e destroy one market for Iju-Shaga as 15 shanty shops burn down, according to rescue officials for Lagos.


At least 23 buildings and 15 vehicles, wey include 11 Cars, two mini trucks, one bus and one heavy duty truck, na im di explosion burn down.

Comments

Popular posts from this blog

Feels good having one of the biggest bums in Nollywood – Didi Ekanem

Chika Ike Flaunts Her Expensive Dog On Social Media